
Naija Jokes vol 2 โ Hustle Ooh ๐คฃ
. Hustle my dear make you no follow people wey dey call luxury life a vanity life ooh.๐น๐น๐น
7. Abeg hustle up make you no dey dream say na for NaijaBet your destiny dey ooh.๐ฐ๐ฐ๐ฐ
8. I say make you hustle ooh make your pikin no dey type โI receive itโ and sharing posts upandan for social media to claim wealth.๐คช๐คช๐คช
9. Bros hustle well ooh make you no dey share referral links anyhow just to make visual money wey you no fit withdraw.๐ค๐ค๐ค
10. Just hustle ooh make your pikin no dey do pay 2k and get 20k in 48hours.๐ง๐ง๐ง
11. Hustle ooh make dey no use your pikin act Devil for Primary school drama and use your rich neighbour children to act Angels.๐คฏ๐คฏ๐คฏ
12. Sister hustle and make your wealth ooh make you no dey ask for T.fair from your boo before you can see him.๐๐๐
13. Guy hustle ooh make she no leave you follow rich guy and you go come dey say all girls na the same.๐๐๐
Related stories
Naija Jokes โ The Aboki Okada Rider
14. Hustle ooh make dey no use your teeth as bottle opener for una family meeting.๐คธ๐คธ๐คธ
15. Hustle ooh make your friends kids no see you begin hide their biscuits.๐๐๐
16. Hustle wella ohh make your paddy no wish you happy birthday after 2days of the main date saying โsorry it came lateโ.
They no dey forget big man birthday oo.๐พ๐พ๐พ
17. Hustle ooh make you no go wear NYSC Jungle Boot go party.๐ฃ๐ฃ๐ฃ
18. Hustle my guy make your babe no tell you goodnight when she still dey online dey chat rich people ooh.๐ฌ๏ธ๐ฌ๏ธ๐ฌ๏ธ
19. Hustle ooh make EFCC no come your area and arrested everybody except only you.๐ง๐ง๐ง
20. Hustle wella oh make we no dey see your account number on every platform for giveaway.๐๐๐
21. Hustle on your own ooh make you no go carry your bank details give scammers, hoping that you go get COVID-19 palliative money ooh.๐ป๐ป๐ป
Naija Jokes vol 2 โ Hustle Ooh ๐คฃ
22. Hustle ooh make you no dey call rich people ritualists.๐บ๐บ๐บ
23. Hustle ooh make you no turn to corporate begger, begging people for money in coded way, claiming that you lost your wallet.๐ค๐ค๐ค
24. Hustle ooh make you no see person wey dey flex his wealth and begin talk say na vanity upon vanity.๐ค๐ค๐ค
25. Hustle abeg make your brotherโs wife no hear say you wan visit come hide her new soup and bring out sour one when you show.๐๐๐ฅบ
26. Hustle ooh make you no dey tell your pikin say sour egusi soup dey cure malaria.๐๐๐
27. Hustle ooh make your pikin no begin see Shoprite as London.๐๐๐
28. Hustle abeg ooh make people no call you from their office come dey ask you if NEPA don bring light.๐ฒ๐ฒ๐ฒ
29. Hustle ooh make dey no come dey use your name as point of contact for poverty.๐๐๐
30. Hustle ooh make babes dey rush you whether you give them transport money or not. ๐
32. Hustle ooh make you no follow believe in โtype Amen and shareโ to get wealth.๐คฅ๐คฅ๐คฅ
33. Chelsea fans hustle ooh, make you no go support Man United to score against Chelsea for Standford Bridge because say you played away to score.โฝโฝโฝ
34. Hustle ooh make you no only enjoy riches for your dreams and imaginations.๐๐๐
35. Hustle abeg oh make you no dey point one old man for village dey say na him cease your destiny.๐คก๐คก๐คก
36. Hustle wella ohh make they no go use โฆ100 suya take your babe.๐๐๐
39. Hustle ooh make you no dey curse NEPA when dey cease light while your mates dey use Solar system 24/7.๐ก๐ก๐ก
40. Hustle ooh make person no come use emoji cover your face for their picture before uploading it oo.๐ท๐ท๐ท
41. Hustle o make u no use sim 1 free mode finished then you switched to sim 2 free mode for Facebook.๐๐๐
42. Hustle o, make another man no carry your babe for front seat you come sit down for back they enjoy AC.๐๏ธ๐๏ธ๐๏ธ
43. Hustle o make bread and soft drink no come be your favorite food.๐๐๐
44. Hustle ooh make your pikin no follow you call scamming a soft work.๐ค๐ค๐ค
45. Hustle ooh make politician no give your mama 1 package of Noddle come show her face for NTA news as a less privileged.๐บ๐บ๐บ
46. Hustle ooh make you no dey call other peopleโs enjoyment a waste of money.๐ธ๐ธ๐ธ
47. Hustle ooh make your friends no comot from your wedding reception and enter viewing center just to watch EPL Swansea VS Bournemouth.๐ฎ๐ฎ๐ฎ
48. Hustle ooh, make you dey observe things wella. Na because you no dey hustle tight make you no notice say this hustle lines no get numbers 31, 37 and 38.๐๐๐
49. Hustle up oh make your favourite online question no turn to โabeg who go sub for meโ?๐๏ธ๐๏ธ๐๏ธ
50. I say make you hustle ooh so that you no go dey use experience dey tell people to hustle ooh just like I did.๐คฃ๐คฃ๐คฃ
Oya add your own ๐ ๐คฃ ๐
Naija Jokes vol 2 โ Hustle Ooh ๐คฃ
Naija Jokes Source
https://www.facebook.com/naijalikeplay
You must log in to post a comment.